Friday, October 4, 2019
One Chance Thieves Don Plenty o!
Hmmm no be small thing we dey see about this "one chance" theives ooo! Just one week ago, we hear say about 38 one chance syndicates na dem the police force bin parade and dem still con take style outline their tactics, so that all of us go dey very careful as we dey do our everyday waka... Make we also remind ourselves ontop these tactics wey dem bin talk, so that you and me go join hands spread the words make the one chance robbery stop kpatakpata; some of dem na;
- No ever enter any unpainted Abuja taxi within the town and where need go dey to enter motor for the satellite state, and make we dey avoid motor wey no get stickers wey no dey show proper registration.
- No ever accept free ride from any person wey you no ever know...
- No ever enter motor wey dey tinted( meaning say the glass dey black from outside)and if the glasses dey down, make sure say you attempt to whine am up before you enter o!
- No ever keep bank details like codes, account balance sms e.t.c for inside your phones (how much dey wey we no fit carry for head or ask our officer ehn?)
- Anyhow wey you fit ehn, try to avoid to dey waka around with ATM card wey you know say you no go need, especially the one wey you dey use for your savings.
- No ever allow yourself fall victim ontop some kind tactics wey dem dey use like when dem go talk say money wey person thief, full inside boot(that style na old school) or to stand dey watch fight. Oga/Madam take style talk sense give your leg sharp-sharp before dem trap you for there...
These na the ones wey i fit remember for now. But you fit still tell us some, so that we go dey aware and we fit learn con get sense ontop this "one chance" matter...
The kind hunger wey still full ground for we country ehn, na im dey make people dey desperate to do anything just because dem wan take style reduce the effect of this hunger wey dey catch dem...
And on top that one, dem go con dey make innocent and hard working citizens dey fall victims for this kind heartless operations wey dem dey carry out...
Na only God go continue to guide us o.
...ALI INA...
Welcome Back!!!π€
ALI INA |
ALI INA |
I still remain the tallest man with the shortest name, the man wey im name no resemble edokido, e no even resemble ikwokrikwo... My name na Ali Ina!
Subscribe to:
Posts (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...