Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½http://triabicia.com/Ghfππ½to encourage us well well!
π€Hmm d kind wonders wey person dey take him eyes see for dis world, no be here o!π€ As 2019 dey waka commot, wey everybody dey jolly dey prepare, na so we con receive dis sad news wey pain me for liver kumeme..π‘π
π€¦π½Chai! As e pain reach, my mouth no fit talk am but make I try... For Ehatokpe Okpiko inside Ohimini Local Government Area wey dey for Benue State, Eneonche Rosemary wey be very young fine girl, get liver, go hang herself after Christmas day, sake of say her Family been discipline her when she come back for wetin oyibo dey call "ungodly hour"...π―
π€Hmm, as d thing pain her reach because dem bin sieze her phone con break her Sim card, na so she take her time, prepare food for the family, con pretend like say she dey go fetch firewood, carry big basin wey she take hide rope and knife con waka go one very far bush go kpai herself...π π‘π π‘
D tori no finish for there o! E con take like 3 days before d family of dis 20 year old pikin go find her as her body don already dey decay small small...
As e reach dis level, wetin person wan con talk again?π€·π½ Shey na d way wey her family go con enter year 2020 with regrets and tears because of their small pikin wey take laws for her hand go kill herself because of small discipline?ππΎ But wait ooo,π³ tori be say, dem no beat am o, na talk with shout dem shout on top her wey con grow reach dis level ooo...π§ Now d question be say, shey dis kind thing make sense? How we take reach dis level inside dis present generation? Country people, make we yarn!
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½http://triabicia.com/Ghfππ½to encourage us well well!
Subscribe to:
Posts (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...