"My name na Nwamodoh Stephanie... Dem born me on d 23rd of October..." Even for dis her young age when other babes her age dey form Americana on top pidgin, Stephanie just speak pidgin like say she no send say na fine babe she be... She just flow naturally on top d language like say she follow invent am... πLol! As we continue from there go her educational background, she talk say;
"I go primary school for Tadel Model Primary Schoolschool for Mararaba.... I come go Federal Government Girls College for Bwari inside Abuja...now I dey Federal Polytechnic Nasarawa dey study marketing..." Wowπ€ education na d bedrock for every endeavor, na wetin dis beautiful young babe don prove so far because d way wey she dey yarn, ππanybody wey get sense go know say, dis wan sabi something...ππ½ Make I know hype her too much but na d truth be dis...π€·π½ As we continue again, na so we ask her for d occupation wey she dey pursue right now and she talk say;
"Right now I be student but I also be part time Model..." Na for here we con ask her say, na how she take be model?π€ She tell us say; "Ah this modeling issues sef don dey my mind for long as I see opportunity for school na e I take grab am so..." βΊWow! Na only person when know wetin e want, dey know opportunity when e show...ππ½ And Stephanie dey amaze me with d way, wey she dey reason like very correct matured Naija babe...ππ½ππ½ππ½ Anyway, to continue especially as we reach wetin make us notice her, na so we ask her say, we hear say you dey contest for something, wetin be dat and how you want make we support you? Sharperly, she respond say;
"If I win dis contest bah I go like inspire young models like me.. Because I be dis shy girl wey no Sabi talk plenty..." Hmm na dis kind thing oyibo dey call 'inspiration by example'... Toh I don dey ready to go vote for her oo coz I dey really feel her intelligent approach unto wetin she dey pursue... ππ½Make una make sure say una follow me ooo!ππ½ So on top general note, how far you go like go for dis modeling path wey you don choose to follow? She yarn say; "Ah go like do am 2 dey successful..." Na so! As nobody dey ever pray to fail for anything wey dem dey do, na so we sef go dey pray make Stephanie succeed as Model so dat she go fit inspire others as she don talk say she wan do am... As time no dey our side again, na so we ask her wetin be her advice to others wey dey like her for dis career path and she yarn sharperly say;
"My advise for young models like me b say... No let fear-fear stop your dreams of achieving wetin you want.. Fear for dis life na bastard so always be up and doing.. AND no forget ooo.. Put baba God first in everything..." πNa here she finish me, coz na only Beauty with Brains dey ever remember say one with God na majority... πAnd na God pass everything... π€Toh las las, on top her sign out words, she talk say;
"Abeg I also get ticket wey una fit buy from me... Abeg help me.. Let's win dis 2geda..."
Omo! If you get conscience when you see fine intelligent babe wey get manners like Nwamodoh Stephanie, you no go waste time to go vote for her Like 5 times or even more sef Like I wan go do now....
Abeg make we make d right choice to vote Beauty With Brains like our daughter, sister, friend and soon to be super model Stephanie Nwamodoh, make we all help her win, God go bless una well well... Just click dis link to vote ππ½
https://meenatnigeria.com/nacfest-online-beauty-pageant-voting-page/ππ½ππ½ππ½ππ½ππ½
No forget to just indicate here if you don vote or on top her social media handles wey be:
FB: (Stephanie Anthony)
INSTAGRAM: (Darien009)
Make we go digital make we give Stephanie Nwamodoh dis chance to make betta difference too!
Make sure say you still click here to support our correct hustle after you don vote Stephanie Nwamodoh... ππ½ππ½ππ½
http://ducolomal.com/2439ππ½ππ½ππ½