Wednesday, December 18, 2019
RITA FIDELIS CHAGWA: "I be Actress and Humanitarian worker..."
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½http://ducolomal.com/1qMQππ½ skip d add and allow God make Him do d rest...
Correct hustle na d message wey we dey try preach for here and by God Grace we get catalogue of intelligent youths wey dey do correct hustle for Naija, because dem wan also contribute for their own small way on top nation building... Wether we like am or not na systems make up society, plus people wey dey d society... Some of these youths dey make betta impact on top different systems where dem decide say dem wan pursue their career... And dat na d reason why we dey like to celebrate dem on top dis blog because everybody wey dey make betta effort to succeed, need encouragement... Our waka today don lead us go d Palace of one Beautiful and Intelligent Adamawa State Sweet babe... Oh!π€¦π½ Make liver no fail me because dis babe sweet to relate with, I no go lie(π€ͺKai! Na wetin you dey think?π²) πAnywayπ, as we dey normally do am, we go allow her take her mouth chop d onions by herself... Make we meet our guest today;
"My name na Rita Fidelis Chagwa... Dem born me for Shuwa, one development area for Madagali LGA for Adamawa State..." Wow! Make I no talk too much sha... Anyway, on top her educational background, she yarn say; "I attend Central Primary School Shuwa, come enter Christian Secondary School for d same Shuwa... I come get Admission for
University of Maiduguri where I bin study B.SC Health Education..." π€Omo! I bin no know say Madagali get fine fine intelligent and intellectual babes like dis ooo...π Na there I go throway searchlight for wife now... πLol!π As we continue, unto who she con be, so dat all of us go know where her career path dey and where her passion lead her to, she talk say;
"I be Actress and Humanitarian worker..." Wow! Toh dis wan mean say dis babe get betta heart to serve humanity and na another point she don score for Madagali people be dis oo... πMy search light don kukuma enter gear 2... πLol!π Out of curiosity, na so we con ask am wetin be her drive, wetin make she dey pursue dis her career like so... She no think twice as she talk say;
"Na because of the passion wey i bin get for dis acting since when i dey small na in make I dey pursue am, and na wetin dey fuel my drive because with dis wan, I fit create impact on top humanity sef..." πDis babe reasoning dey leave me speechless Like Micheal Jackson bin sing ooo, na now i really con understand dat song wella...π€ πMy love searchlight for Madagali babes don enter gear 3 now so... πLol!π Okay on top wetin she go like achieve with wetin she dey do apart from wetin she don already talk, she still talk say;
"International Recognition, and like i talk before, i wan make good impact ontop people..." Na for here we con ask her say na how long she don waka for her career and as a simple and intelligent Madagali babe with sauce and respect to God, she yarn say;
"To God be the glory, I don dey go places..." π€Omo! Dis babe don succeed to carry my searchlight and interest on top πMadagali babesπ©π½ go gear 4... I hope her State Government dey see say na very good ambassador of her people she be so... πLol! Toh, na who con be your mentor and person wey you wan be like for dis field? E no take her anything to sharperly answer say na;
"RMD..." Omo see levels! Some kind mentors dey wey dey give hype and others, levels... Dis na one of d kind mentors wey dey elevate person level like Rita Fidelis Level go soon change... πLol!π So as e be so we con wan kukuma know how long she don dey waka for her career path and she comfortably tell us say;
"Na 3years now..." Wow, she no be new player for d game... No wonder when we ask her say na which kind thing she go like leave as legacy wey people go take remember her, she talk say; "Great legacy..." Okay as Time don dey give us signal to finish dis session of interview with Rita Fidelis, we con sharperly find out if project Dey wey she don do or wey she joinbody do and wether stars bin dey inside, she talk say; "Yes Yoruba demons wey involve Ramsey Noah, Jim lyke, AY, Falz de bad guy and plenty of them..."
Onto her las las words before she finally sign out go enter her limousine waka go continue her correct hustle, she yarn say; "Make dem believe in their dreams, follow
am jeje to where e go help dem be good
Ambassador for our country Naija..."
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½http://ducolomal.com/1qMQππ½ skip d add and allow God make Him do d rest...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
Make I be the first to encourage you like d person wey write this your interview... Babe, 2020 we go gather to watch you clinch award for AMVCA
ReplyDeleteWhat are a fantastic mix. Shout out to yah.
ReplyDelete