Monday, February 4, 2019
Two Nigerian Lecturers Don Die, One injure 4 Ghastly Motor Accident As Dem Dey Road Go House, After Dem Attend Friend Wedding 4 Jigawa
From Fadabubu...
Two friends Zaharadeen Hussaini Kaita and Abbantea don die for inside one serious accident as dem been dey go back to their house after they attend their friend wedding for malam madori local government area for inside jigawa state.
The third friend wey him name na Yusuf Dot Java been get serious injury as him dey inside hospital.
The accident happen along Ringim Kano road. Before Zaharadeen Keita Die him be lecturer for inside one polytechnic for katsina state and Java na lecturer for one polythecnic for Zaria.
The person wey dem go him wedding wey him name na Babangida Isyaku been go him facebook to go pay tribute to him friends dem and as him pray make the other one wey get injury heal fast fast.
Mosquitoe Wahala For Kano: 3 sisters don die inside sleep, after dem use insecticide...
From Fadabubu...
Three sisters wey dey stay for Badawa layout of Nasarawa Local Government Area wey dey kano state don die as they take sleep inside the house wey dem spray that thing wey dey kill mosquitoes and other insect wey oyinbo dey call insecticide inside...
Walida wey dey 22 years, Zakiya wey dey 20 years and wasila wey dey 18 years na daughters of one one businessman Alhaji Salisu. Dem been go sleep on Saturday na only to see their dead body the next day for house.
One of their neigbours talk say this young ladies fit don spray insecticide for inside their room wey fit be the cause of this bad thing wey happen.
As them take talk; dey say mosquitoes too much for the area wey make pipo to start to dey abuse insecticide so that mosquitoes no go bite dem again.
The Kano police command talk talk person DSP Abdullahi Haruna, confirm this thing wey happen as him talk say dem don carry the body of this girls go hospital to know wetin really kill dem.
See who people Dey Call "thief"..."ole " For Kwara State... @elderkeef
From @elderkeef
Senate Presido, Bukola Saraki enter him State for Kwara for Okuta Baruten make him go do campaign na him, him Pippo dey Shout βThiefβ "ole". E be like them Don tire with magomago when them dey see. My pippo vote wise dis time o... I no dey for I shoot bird, the mama fly o. Look the video for the π link below to confam the Tori...https://www.gistmania.com/talk/topic,376607.0.html
Smoking; How e take Affect you? @elderkeef
From @elderkeef
My pippo smoking π¬ no good for our health... No go dey smoke because you see person dey smoke and you like am. Remember say; one man food na another man poison. Make we Dey get sense o... Touch π this video
TRAGIC na d word! Woman Don Die; As Man Wey Invite Am Go Hotel, Kill Am For Niger State
From Ali Ina...
This one na Follow-follow, abi na longer-throat abi na wetin I fit call am? But the thing wey dey make some ladies go hotel go meet person wey you no sabi well-well, I never still understand...
Toh, as e be like dat, Dem Don Kill One lady inside one hotel for Niger State. We hear say, the lady wey we never hear her name, been come the hotel come visit person and we believe say na the person wey invite am, naim still kill am for one kain annoying way...
According to one online report, dem say, dem cut her throat, commot the things wey dey there... Chai! If you see am, you go faint if you no get mind...
One Facebook user wey be Adegwa Emmanuel Terkura wey come from Benue State, but dey live for Minna, Niger state, share the story as him dey warn ladies make dem dey very careful of the kind people wey dem dey follow, so dat dis kain thing no go happen again... Toh shey na when something happen to person, dem go use am warn other people. But pray say make e no be you wey e go happen to, wey dem go con dey use am warn other people say make dem dey very careful...
Chai! Teddy Panel-Beat Him Girlfriend, Esther; Because She Invite Her Friend Come Him House...
From Ali Ina...
Hmmmm when I hear some people story ehn, na then I dey understand say, Tru-tru, common sense no dey common atall... Just after we think say we don do justice to the issue of domestic violence, we con hear say another one Don happen again... One lady, wey her name be Esther, don receive beating full drum, on Saturday 2nd Feb 2019, because she invite her friend, wey him name na Teddy, come her boyfriend house for Abuja, na there the drama con take place...
We hear say, Esther been don pay N50,000 to Teddy, say make him help her to buy phone, but the deal no con work out like that as Teddy con agree say him go return only N30,000...
So, last week, Esther con tell her friend say make him come her boyfriend, Festusβ house, drop the money, but as him reach there, the two friends con dey argue ontop the matter...
This thing con vex Festus, and ontop of the embarrassment, him no waste time as him begin to panel-beat him girlfriend sake of say she go invite another Man come him house. But we still hear say, no be the first time wey Festus dey panel-beat Esther be dis... My sister, borrow yourself brain na... As e be so, you don turn to punching bag when dem never even pay your bride price. Commot from the relationship na, before dem carry your deadbody go your people ooo...
Chai! See wetin Poverty Dey Cause... Mother sell her own pikin for N200k to open provision shop
From vivian
The Niger state Police command don arrest one 23 year old Blessing Aluna, sake of say she sell her one week old pikin for N200,000.
According to reports , we hear say police arrest Blessing with one Oludare Jeprince, sake of say, na two of them been put hand to sell the pikin. This Blessing wey dey stay for Rimi lokoja, Kogi state, talk say this Oludare wey follow her sell the pikin na her boyfriend...
When police interrogate blessing, she con dey blame poverty, she con dey say βimagine I sell my own pikin for money, to tell as hardship don dey this country , I sell my own pikin for 200 thousand Naija, make I for fit open provision shop for suleja at least to take care of my siblings."
Blessing talk say she regret her actions. Say expecially to her own pikin , say she no think say she deserve to be alive ...
Confirming their arrest, the commandβs talk talk person Muhammad Abubakar, talk say they go arraign the suspect for court after they finish their investigation...
Subscribe to:
Posts (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...