Monday, February 4, 2019

Chai! See wetin Poverty Dey Cause... Mother sell her own pikin for N200k to open provision shop




From vivian

The Niger state Police command  don arrest one 23 year old Blessing Aluna, sake of say she sell her one week old pikin for N200,000.

According to reports , we hear say police arrest Blessing with one Oludare Jeprince, sake of say, na two of them been put hand to sell the pikin. This Blessing wey dey stay for Rimi lokoja, Kogi state, talk say this Oludare wey follow her sell the pikin na her boyfriend...

When police interrogate blessing, she con dey blame poverty, she con dey say  β€œimagine I sell my own pikin for money, to tell as hardship don dey this country , I sell my own pikin for 200 thousand Naija,  make I for fit open provision  shop for suleja  at least to take care of my siblings."
 Blessing talk say she regret her actions. Say expecially to her own pikin , say she no think  say she deserve to be alive ...

Confirming their arrest, the command’s talk talk person Muhammad Abubakar, talk say they go arraign the suspect for court after they finish their investigation...

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land