Friday, January 18, 2019
OMG! Corpse Of An Unidentified Teenager Found Lying On Murtala Muhammed Highway, Calabar From VIVIAN SUNDAY
From VIVIAN SUNDAY
Hmm God go
help us o... Hmm as i dey waka dey drive for road, my waka carry me reach
calarbar , na so i see some thing wey make me match break o.
I hear say dem
don see the corps of one teenager for murtala muhammed highway
, by bishop
monyagh avenue , Cross River State.
But as i
take eye see the body , this teenager go dey around 13years. I no see any
injuri for this teenager body except skin infection for Him waist. Wetin make this boy die we never know but as
soon as we get reason, we no go take time we go con tell you .
But as e be
so dem don tell the police and order health authorities make them carry the
body...
Two Notorious Hoodlums Stripped Nak3d, Beaten And Paraded By Soldiers In Nasarawa From Ali Ina
Two Notorious Hoodlums
Stripped Nak3d, Beaten And Paraded By Soldiers In Nasarawa
From Ali Ina
Road don
close for some notorious criminals after Soldiers gbab them for inside Nasarawa
State.
Na so Dem
give the Two suspected hoodlums the beating of their lives after dem gbab them…
According to
reports, the suspects been don dey terrorize one community inside
Nasarawa/honeypot Local Government Area of the state, before the military men
con gbab them redhanded…
Dem first
naked the men, before the soildeirs con beat-beat them, then con disgrace them
for public…
Them later
hand the suspects over to the police for further investigation and
prosecution….
4. I won’t accept this child until paternity test proves I’m the dad, man tells wife(KADUNA STATE) From Ali Ina
I won’t accept this child
until paternity test proves I’m the dad, man tells wife(KADUNA STATE)
From Ali Ina
One
29-year-old woman, Rahma Yakubu, on Wednesday don drag her husband, Jibril
Bajeh, go one Sharia Court wey dey siddon for Magajin Gari, inside Kaduna
State, because say Him no gree say their three-year-old son, Abdulhalim, na him
own...
Rahma tell
the court say Bajeh been abandon her when her belle been dey eight months,
because of one misunderstanding wey them
get.
She tell the
court say, she and her newborn pikin been dey live with her brother after Bajeh
cut off all communication with am. She talk say,
“My mother
call am to tell am say I don born pikin for am, but him tell her say him no go
accept the pikin until him confirm am through wetin dem dey call DNA test,” Na
so she tell the court.
Rahma been
also talk say their parents been don also try say make dem settle the matter,
she even tell the husband say make him try to agree to take responsibility of
the pikin welfare until when the result of the test go commot.
The
complainant also beg the court say make them scatter the marriage since her
husband don use mouth to divorce am already.
For him
defence, the man tell the court say him divorce him wife for 2015 because of
say she dey do touch-touch with other people even as she dey married to am, na
that thing make am deny the pikin after them born am.
The Judge,
Musa Sa’ad-Goma, come rule say “since the defendant don confirm say him want
make their marriage scatter, the court go present divorce certificate to the
complainant.”
Sa’ad-Goma
still talk say the legitimacy of the child, that is who go get the pikin, dem
go discuss am with the Parents on January 24.
Delta Polytechnic Student, Peace Vera Killed By Speeding Vehicle While Returning From School From Ayim Raymond
1.
Delta Polytechnic Student,
Peace Vera Killed By Speeding Vehicle While Returning From School
From Ayim Raymond
Haaa, wetin
be the meaning of life? Wetin be d main tin weh person dey live for? Today you
live, tomorrow you die, you see person today, tomorrow no more, you wey dey
alive now wetin you dey do, to help yourself, your future and d people wey dey around
you? You don ever ask yourself where you dey go if you no dey today again, and
ee get any good thing weh people go talk about you wen you no dey? Just know
say no body dey plan for death, ie fit come at anytime.
All this
things weh I the talk, na from the kind thing weh I see for Delta State
yesterday, after one motor weh dey for high speed, kill one young girl weh her
name be Peace Vera as she been just the return from school.
Oh, I dey
see plenty tears for the eyes of this girl family members as she just meet her
end yesterday for this big accident inside Delta.
We gather
say this girl and her friend wey be Ovo, been dey come back from their school wey
be Delta State Polytechnic, Ozoro, wen one motor wey been dey for high speed
come knock them down as them dey try to cross road go buy something for Effurun
roundabout.
Them say
Peace die immediately while her friend been get serious injury, them say them
cari her go hospital but she dey for bad condition.
So all her
friends don dey mourn her for social media, ohh. Abeg try to guide yourself
first, if you dey waka or drive for road, try to know how to do your waka, if
you no no, try listen to Security and Safety Maters for Human Rights Radio,
every Thursday from 7 to 8pm so that them go teach you to secure yourself.
Pastor nabbed with bag filled with female pants and bra in Auchi, Edo state
Pastor nabbed with bag
filled with female pants and bra in Auchi, Edo state
From Ayim Raymond
One man weh
claim say him be pastor, them don gbab am yesterday with one bag weh full with
plenty pants and bra for Auchi, inside Edo state.
According to
reports, na members of the state Vigilante na them gbap this pastor weh dey
waka dey preach in the mornings, come dey ask day, wehtin dey dey the big Ghana
Must Go bag weh him cari dey waka with.
Na so them
come collect the bag come search am, as dem come see plenty plenty pant and
bra, na so people come dey shout “ Ewooooo Pas…..tor” heyyy, from there, them
come cari am go him church, na there, them come see the real pant and bra
depot.
Just see as
some dey spoil the woke of God, Chai! .
STREET BEGGARS WEY NO GREE HEAR WORD FOR KANO GO LAND FOR COURT
Street beggars wey no gree
hear word for Kano go land for court
From Busayo Olowookere
Kano State
government on Monday arrest 35 beggars
across di state wey dey beg for street.
Na for 2013
former govnor Rabiu Kwankwaso pass law wey ban all forms of begging for any
street for Kano.
Nabahani
Usman wey be chairman of di Anti Street Begging Unit, tell news pipo say those
pipo wey dis na dia first time wey dem dey catch dem, dem go release dem afta
serious warning, but di ones wey don commit before na straight to court dis
time.
"From
time to time we dey go round to arrest beggars and di problem aspect now be say you go see plenti pikin wey
suppose dey school but dia parents or guardians carri dem come or lease dem to
help dem beg."
One of di
beggars wey speak to news story pipo been talk say na lack of wetin to chop
make her dey beg.
" say
If government go help me with moni to start business, I no go beg again,"
naso she tok.
Afta former
govnor Kwankwaso pass di bill, di plan be say every month government go dey
give those with disabilities chop moni for di state but till now dat plan still
neva dey work well well..
From Busayo
Olowookere
Subscribe to:
Posts (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here 👉🏽 http://ducolomal.com/1qMQ 👈🏽 skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link 👉🏽 http://locinealy.com/1FaJ 👈🏽 and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here 👉🏽 http://triabicia.com/Ghf 👈🏽to ...