Friday, January 18, 2019

Delta Polytechnic Student, Peace Vera Killed By Speeding Vehicle While Returning From School From Ayim Raymond


1.                  Delta Polytechnic Student, Peace Vera Killed By Speeding Vehicle While Returning From School
From Ayim Raymond
Haaa, wetin be the meaning of life? Wetin be d main tin weh person dey live for? Today you live, tomorrow you die, you see person today, tomorrow no more, you wey dey alive now wetin you dey do, to help yourself, your future and d people wey dey around you? You don ever ask yourself where you dey go if you no dey today again, and ee get any good thing weh people go talk about you wen you no dey? Just know say no body dey plan for death, ie fit come at anytime.
All this things weh I the talk, na from the kind thing weh I see for Delta State yesterday, after one motor weh dey for high speed, kill one young girl weh her name be Peace Vera as she been just the return from school.
Oh, I dey see plenty tears for the eyes of this girl family members as she just meet her end yesterday for this big accident inside Delta.
We gather say this girl and her friend wey be Ovo, been dey come back from their school wey be Delta State Polytechnic, Ozoro, wen one motor wey been dey for high speed come knock them down as them dey try to cross road go buy something for Effurun roundabout.

Them say Peace die immediately while her friend been get serious injury, them say them cari her go hospital but she dey for bad condition. 
So all her friends don dey mourn her for social media, ohh. Abeg try to guide yourself first, if you dey waka or drive for road, try to know how to do your waka, if you no no, try listen to Security and Safety Maters for Human Rights Radio, every Thursday from 7 to 8pm so that them go teach you to secure yourself.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land