
"My name na Alkali Matt. Na from Kaduna State I come from and na March 7/1984 dem born me..."

Hmm see fine guy no pimples... Person wey e be like say no sabi tear pidgin but im show me say, I dey learn work for im side on top pidgin... Lol! Him tell us say na from
"University of Abuja" him finish from but time no dey for am to tell us wetin him study but... E be like say na art related, because Alkali Matt get sweet voice wey him dey take sing better songs for church well-well(but dat wan na story for another day sha)...
OK make we continue... Una kukuma know say na curiosity dey kill the cat but for dis matta, na im make us dey go out there, go torchlight and bring all these beautiful and handsome celebrities wey dey come up, so that dem go tell us about themselves and you ma, go learn something from dem... So, when we ask am say wetin him don achieve with wetin him dey do, Matt talk with humility say; "na small fame but the aim na to achieve success"
As things be so ehn, you fit see say Matt na person wey no dey talk too much but as him dey answer the questions jejely, him no get wahala... On top how far him don go for this him career, Matt yarn say;
"I never reach where I dey dream to reach but I no dey d level wey I been dey few years ago..." Dat na true and na correct talk from correct guy! As him continue... When we ask am say wetin be the legacy wey him wan leave, wey people go remember am for, him humbly reply say;
"I wan use my talent and achievements impact and touch people lives positively"... Another correct talk from our correct guy! As e be say we go soon dey finish our yarn for today, we con take style ask am wether project dey wey him go like us to know about... Na there him con tell us say:
"I currently dey on Mnet project Halita wey dey show ontop Africa magic family and Africa magic hausa."
Chai! Our guy don make big entrance oo! Anyway, every success story get where e start from and we believe say na here Alkali Matt own take start... On top him advice to upcoming talents and final talk, Matt yarn say; "my advice to upcoming talents be say make dem pray, believe in demselvs, work hard, do their assignments well, avoid shortcuts and leave the remaining matta for God hand...
D Final thing wey I get to talk about na wetin dey affect the film industry especially. I go like to beg d producers make dem no dey take advantage of d upcoming talents, at least make dem dey appreciate dem becos dis upcoming talents dey go through plenty things sake of d passion wey dem get. If producers produce films make e no end inside their lappy. Na d 1 wey dey pepper me for body be dat. Thank you for de opportunity wey you gimme to talk my mind." Dis na better talk wey we get with Alkali Matt today and make una no forget say him na one of the recipients for the Black Giant Signature, African Giant Strides Awards for Fastest Rising Actor of The Year Category... You fit follow this link to vote am;