Tuesday, December 17, 2019

16 Year Old Barber Don Enter Gbege Sake of Say, Him Steal Phones For Church...


We still dey beg una to take at least one minute make una click dis link πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1PlsπŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½ na una own way to encourage our correct hustle so dat we go dey encouraged to do more...





HALIMA OLANREWAJU

Police don arrest one 16 years  old barber, sake of say hin steal phone for inside church...
As we dey checkmate d mater, we con find out say dis boy and hin friend act  enter d church say dem be member... As praise and worship dey go, na so den take thief one Mr Joseph  phone wey worth N145,000. As Joseph shout say dem don thief hin phone, na so d boy friend wey den join body go  thief take run ooo... As e be now, dem don carry dis boy go court, and  him dey face two count charge of magumagu and thief...

The magistrate wey be Osunsanmi say, make dem bail am with N400,000 as d crime wey hin commit break d rule of section 287 and 411 of the state for d year 2015
She con carry d case go December 27...

We still dey beg una to take at least one minute make una click dis link πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1PlsπŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½ na una own way to encourage our correct hustle so dat we go dey encouraged to do more...

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land