Tuesday, December 17, 2019

Person Go Hire Kidnappers, To Kill Him Brother 7 Year Old Pikin After Dem Pay N300k Ransom...


Abeg, make una no forget to support our correct hustle ooo click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1OvVπŸ‘ˆπŸ½ to show say you support us... God go bless you nyafu nyafu!!!

HALIMA OLANREWAJU


My people dis one wey I wan tell una, na d one wey go touch ur liver kumeme...
 Police don  arrest  one man wey hin name na Faruk Seidu  with hin friend inside Abeokuta, sake of say  dem join body go kidnapp and kill hin brother son.
As we con dey checkmate d matter, we con find out say dis Faruk wey kidnap hin brother pikin, say make hin brother give am money say he wan use am marry another wife but as hin brother no gree give am, nah hin make am kidnap d pikin oo...

Another tori wey dey inside dis matter be say, dis man don marry two wives before, but one don die and hin don divorce d second one... My people, hin matter con be  like cow wey den carry for head wey know no say, to waka na work, hin con tell hin friend make dem call hin  brother say make he bring N5million con carry hin pikin, na so hin brother begin dey beg dem say hin no get money wey reach like that oo. Hin con tell dem say, he fit raise N300,000 naira give dem, na so dey gree collect dis money... After den collect d money finish, nah in Faruk kill hin brother pikin  go throw am for river, sake of  say d pikin don see hin face and hin brother fit kno hin secret if dem allow d boy go.

Abeg, make una no forget to support our correct hustle ooo click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1OvVπŸ‘ˆπŸ½ to show say you support us... God go bless you nyafu nyafu!!!

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land