Wednesday, December 18, 2019

One correctional officer go go tanda for prison, sake of say e go chook hand for employment wuru wuru...


Support our correct hustle... All wetin we need you to do, na to just click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1yAPπŸ‘ˆπŸ½ skip d add shikena! And God go bless you nyafu nyafu...

 From NENYE NWOBU.


The high court wey dey for Abuja say e don grab one man wey dem say na officer for Kuje correctional Centre, him name na Ahmed Abdu, and e go dey four year for prison house because say e go chook hand for kurukere waka wey oyibo dey call fraud when dem dey give people work.

Independent corrupt Practices and other Related Commission wey be ICPC come make us know say dem bring Abdu come court for 2014 by den, because him use wuru wuru collect one Adamu Abubakar N250,000. And dem say him don collect dat kind money from five other people sake of say e go give dem work for any work wey dem choose inside; Nigeria Immigration Service, Nigeria Civil Defence Corps and Nigeria Correctional Service, e even sign undertaken say e go return their money if the thing no work...

ICPC, for wetin court dey call two-count charge, tell court say make them tinap this man because e dey use him position dey do kurukere waka with people money for work wey no dey exist. Say this thing wey e do, dey against section 10(a) (ii) of Corrupt Practices and other Related Offences Act, 2000 and so dem fit punish am under that section.

Before dem sentence this man wey dem dey call Abdu, who nobody represent for court, the man beg court make dem take am softly for him punishment, because say na this be the first time wey him dey do this kind thing and say na him be first pikin wey im  mama born for him big family, e no go like make im  people suffer because say na him be their hope so...

The ICPC counsel wey be Ngozi Onwuka say make court make Abdu pay all the people wey him collect their money.

Justice Kutigi wey dey decide this case say e understand say Abdu dey beg say make dem take am jeje with am but say the only thing wey court give am power to do na to enforce law. So because say this case so, don show say true true, Abdu dey use im  position as public officer to do some kind bad bad things like this money matter so for job wey no dey exist. And na so the Judge come complain say this thing wey this man do so don full everywhere for we country, so the thing wey court wan do so na to make other people no follow Abdu hustle so e go put this man for two years inside prison with no option say maybe if e pay fine dem go fit release am and say na so e go dey do people wey still commit this kind offense.
Support our correct hustle... All wetin we need you to do, na to just click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1yAPπŸ‘ˆπŸ½ skip d add shikena! And God go bless you nyafu nyafu...

1 comment:

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land