Wednesday, January 23, 2019
Na wa o! Wetin Married Man Dey Find For 7-year-old Girl Body For Delta State...
From Ayim Raymond...
Police don gbab one 44-year-old married man, sake of say him go enter one 7-year-old girl for Sapele area of Delta state.
According to reports, this suspect weh them arrest few days ago na papa of two children, and them say him name na Promise.
After them arrest am, him agree say him commit the crime, and him come dey even talk other bad bad things weh him don do as him confess say him been enter one eight year old girl for him area and use finger enter another one.
The man later confess say him sleep with the girl more than two times.
We hear say them go transfer the mater go Asaba police command for further investigation
...
9. 28-year old student?jailed for stealing N1.1m in Jos
From Busayo Olooekere
the kasuwan Nama Upper area court for inside jos don sentence one 28 years old student Shamsudeen Suleiman to one year imprisonment sake of say him been break enter inside person house come steal 1.1 million naira.
The judge wey him name na Yahaya Mohammed talk say d punishment go serve as example to the other people wey wan do wetink this man do. Him come order say make the convict pay back 650,000 thousand naira, and say d court go pity am because na d first time wey him been try do this thing.
The prosecutor Abubakar Musa, tell the court say dem been report one case of theif theif on dec. 19 2018, for Nigeria Security and Civil Defence Corps, plateau command, by one Junaidu Ibrahim. Musa talk say the convict wey dey stay for inside Nassarawa Gwon, been break enter inside the house of the person we bring complain come and him come go with one box wey 1.1million dey inside.
Suleiman been plead say him dey guilty to the two count charge wey dem talk say e contravene section 287 and 254 of the penal code.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment