Thursday, January 31, 2019
Na wa o! 45-year-old Man, Rape Him Daughter, Say Na Devil Cause Am...
From Fadabubu
The ogun state police command done arrest One 45 years old man wey him name na Idowu Owolabi... Sake of say, him use force enter him 21 years old daughter.
As the state talk talk person for the police wey be Abimbola Oyeyemi talk say Owolabi wey get 3 wives start to dey enter him daughter last year for their house wey dey for Papa Olosub area for inside Oja-odan for inside yewa south local government area of the state.
Them arrest this suspect after him daughter been report am give police pn January 28.
This girl been report say she follow her father go farm for inside Fagboun village and na so her father come use by force enter her for inside farm for march 2018. She still talk say na so her father continue to dey use by force enter her and him still come tell her say him go kill her if she tell anybody.
As dem take get the report, na so the DPO of Oja-odan wey be CSP Olayemi Jacob been lead police pipo go this suspect house and na so them arrest am sharp sharp.
Abimbola still come talk say the commissioner of police Ahmed Iliyasu done give order say make dem transfer the case go one state criminal investigation and intelligence department so that dem go shine eye inside the matter well well and make sure say d law take en cause.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment