Wednesday, January 23, 2019

Chai! Dem Don Find Newborn Pikin Dead For Dustbin Inside Owerri ...


(Deborah Odoekwu )

Chimoooo! Which day be that wey I go Uromi wey dey Edo state wey I report say person abandon im pikin for inside one bowl come keep am near one catholic church wey dey the area. We never finish to dey talk dat on o. na im I come go Owerri for Imo state wey we hear say dem find one new born baby inside dustbin! Hey! People wicked oooo!!

We come go chuk ear for the matta well well come hear say dem find this pikin for one dustbin wey dey Ama-wire junction for Owerri.

We hear say this one dey happen just after some months wey just pass wey dem also find anoder pikin wey die after person dump am for dustbin again for that same Owerri. Say dem discover say this pikin wey im mama thruway for dustbin, bn done die by the time dem see am for inside the carton wey person chuk am put.

Prince Victor Ebukason wey come put the picture online come talk say, who be that person wey do this kin bad tin? Say dem find dis baby dead body for the Dust bin wey dey new Owerri World bank market yesterday evening and as im see am, im just weak, say im no even fit chop or do anything because wetin happen to dis innocent pikin still dey pain am. Im talk say make God have mercy on this our generation.

But me I dey wonder why person go carry im pikin go thruway for dustbin? Even if you no fit take care of am, why you no go carry am give people wey wan adopt pikin, ehn? Kai! This one weak me oo come chuk my liver kumemmeee! Hai!

Hmm

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land