Wednesday, January 23, 2019
Shuu! See As God Punish Person Wey Wan Use Juju Win Baba Ijebu...
From VIVIAN SUNDAY...
one man wey dey go look for spiritual power so that hin go fit win lottries sharp-sharp, we hear say hin don go blind. This story we get am from the News Agency of Nigeria (NAN)...
Emanuel wey be the victim wey dem no gree tell us him real name, go look for help from dibia wey dey for ishiagu village near ogwashi uku, inside Delta state, say make him for get eyes to see lucky numbers. Hmmmm one friend of the victim, wey him name na Osita, tell the News Agency of Nigeria on Sunday for ogwashi uku say the incident happen after 12 days don waka comot from January, 2019...
Na wetin hin tell them be this βhim go see dibia make him for help am win lotto game aka baba ijebu. Hin don tell me say hin no dey fear to play lotto game sake of say hin knw say, hin go win..according to am , Emmanuel go look for help for dibia and hin tell am say make hin no worry hin go help am. Say na so dibia prepare concotion for am,say the dibia give am the concoction make him drink con tell am make him rob am for hin eyes, Emmanuel no tell anybody wetin hin do until the eye no con gree open again na so hin con dey shout, na as I hear am from one of our friend, I con go see Emmanuel before hin con tell me wetin happen...
We carry am go hospital , as the eyes don swell up, but the doctors no fit do anything... Now hin no dey see again from wetin the News Agency of Nigeria gather , we hear say the dibia don run go hide for where nobody go see am , and say they still dey look am...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment