From Fadabubu...
Dem don catch and beat one female kidnapper as she been try to kidnap 3 children for inside Oyo state. This suspect wey dem identify as Tawa been meet this children for Mokola area of Ibadan wey be the state capital, where she been one kidnap them.
As one person wey see as this thing take happen talk say the woman touch the children with charm naso dey loose control and she been wan carry dem commot for the area.
She know no say one person wey dey sell goods for roadside been dey look her as she been dey dey do wetin she dey do. Naso the the trader come ask her say na where she dey carry the children go, as she no answer na so she shout make pipo come na so everybody come decend ontop this kidnapper.
Dey been give her serious beating before dem carry her go police station
No comments:
Post a Comment