At Last Mercy Eke don win di fourth season of di Big Brother Naija reality TV show.
Afta plenty plenty drama, + romance + fight-fight, inside three months, Mercy ova take Mike wit 41 per cent to win di Big Brother Naija reality TV show.
Na so Frodd , Seyi and Omashola chop eviction on Sunday night before dem announce di winner.
Di show wey begin on June 30th wit 26 housemates bin get three pipo wey become last pipo standing for inside di contest for di winning price on October 6 2019.
Wetin dis one con mean now be say, Mercy go pack 60 million naira waka comot from di house.
So far so good, we fit for dis point carry Congratulations take give Queen Mercy plus her fans dem wey vote am reach the winning level!
Congrats mercy
ReplyDelete