"i bin attend amazing height international school(primary school) then I con do my junior secondary with skyward academy and before i con finish my senior secondary school with St. Paul and Debbie international school and the las las, I do my higher institution for Wolex polytechnic wey dey for Galadima do Abuja..." As we move go front small so dat we go take style enjoy dis smooth ride with Aace Montage,π€ na so we ask am say for benefit of d people wey know really know who him be, make him tell us who him be?π Him con talk say;
"By d Grace of God, i be Cinematographer..." Hmm to be cinematographer for we country today no be small thing ooo,π€ na dem dey control camera shots for film and media and their knowledge of filmmaking and TV dey wide ooo...π Meaning say, dis hussle wey Aace Montage dey so, e make sense die...π€π½π€π½ No ask me question yet ooo, make we follow Aace Montage finish, we go understand... Unto how him take start to enter dis career path, him talk say;
"i love entertainment
Because d thing dey run inside my family bloodline, and I bin start since 2006 with Victor afolayan (Jagwa). I dey there dey learn how to light, before I con later dey do booming. Then from there again, I con start editing. Na then, I con go study camera handling..." Hmm if you see person wey go go far for d legitimate hussle wey him dey do, you go know... And Aace Montage na very good example...ππ½ As we con go front small, na so we con ask am say, who be him mentor(s) or person wey him go like to be like for d field? Him no reason am 2 times Like say him don prepare well well before we con ask am, as him talk say;
CLARENCE PETERS |
"I go like pass message give people through film and preach to the world..." As time no be our friend again, na so we sharperly ask am if any project dey wey him don do and go like make we know about am or d wan wey him joinbody do? Him talk say; "My recent project wey I love well well na "The prophecy" and dis wan na epic movie wey dey preach about sacrifice..." As you dey hear so, make you try go look to dat project so you go know how far Aace Montage don move inside dis him cinematography career... Before him sign out, on top him advice give people wey just dey start, him talk say;
"my advice dey simple "no give up and make sure say you dey focus..." Las las, as part of wetin oyibo dey call "appeal", wey me, I see am as "abeg" for pidgin,ππππ him talk say; "Film sexual harassment don too much for d industry and all of us must try our best to take style dey always fight am..." Make we no forget to try encourage Aace Montage, comment under here to show say you care for young talents wey dey do legitimate hussle...
God bless your hustle Darling. Devil like it or not you will surely get there
ReplyDeleteYou will get there dear
ReplyDeleteEje ,always sabi say we go do this hustle make mama and papa proud. People go hear your name all over the world.
ReplyDeleteAlways sabi say we your family love you and we no go ever leave your side. We tanda gidigba. On God brother
I love this blog
ReplyDeleteI love this blog
ReplyDelete