"MY NAME NA ONUH ENE JOAN AND NA ON THE 17TH OF MAY 1993 MY MAMA BORN ME FOR INSIDE UGBOKOLO FOR OKPOKWU LOCAL GOVT WEY DEY BENUE STATE..."
Chai!๐ฎ D way wey some of these fine babes dey take style scatter pidgin ehn, if you dey for their front, you go just dey smile๐ค mumu ๐คsmile bcoz as oyibo dey talk am "it can take your breathe away..."(if you fit translate am for pidgin, you be BABA... Lol!๐๐๐๐) Make we continue. As I take dey lost inside my mumu ๐คกsmile as her pidgin dey sweet my belle, na so she just take style pinch me back to reality wey make me remember say I suppose ask her about her educational background and wetin she dey do... She continue say; "NA FOR BENUE STATE POLYTECHNIC I FINISH FROM, AND NA THERE I STUDY SCIENCE LAB TECH... RIGHT NOW, I BE FASHION DESIGNER, I DEY INTO ACTING AND MODELING TOO..."
Omo! Dis babe na no dulling babe o! She get swag, she get skills, she sabi book and on top of dat one, she be wife material oo๐(no be talk am ooo!๐) Anyway, as d gist dey sweet dey go, na so we con ask her wetin she dey plan to achieve with wetin she dey do... Na so she yarn say; "I DEY PLAN TO STILL GET ADDITIONAL SKILLS AND TO CONTINUE MY JOINBODY WITH BETTA PROFESSIONAL ASSOCIATIONS DEM..." Hmmm babe wey sabi book ehn... Make I no talk too much sha... Unto wetin she want make people take remember her, she yarn say; "I WANT MAKE PEOPLE REMEMBER ME FOR MY HUMILITY, MY HARDWORKS, EVEN SAY I NO DEY EASILY GIVE UP AND THE KIND BETTA QUALITY OF DELIVERY WEY I DEY GIVE..." As per how far she Don Waka for her career, she still con yarn say;
"I BIN START TO LOVE WETIN I DEY DO, SINCE WHEN I DEY PRIMARY SCHOOL. E BIN NO DEY EASY EVEN TILL NOW, BUT GOD DON DEY HELP ME WELL WELL... FOR MY MODELLING CAREER, I DON ENTER 8 DIFFERENT CONTESTS & BY THE GRACE OF GOD I WIN 6. EVEN FOR INSIDE ACTING, I DON FEATURE INSIDE DIFFERENT MOVIES . AND MY FASHION CAREER NA IM DON ALWAYS BE MY BACK BONE WEY I USE TAKE ACHIEVE THE OTHER TWO. AS E BE SO, I NO WAN STOP HERE BECAUSE I STILL GET PLENTY ACHIEVEMENT WEY I WAN GRAB..." Hmm true true dis babe no dey easily give up ooo... Her talk sef dey make English finish for my mouth because she, na very interesting person to dey yarn with... As we go soon off light on top her interview session, we con kukuma take style ask her how long she wan do dis thing wey she dey do? As a sharp babe, na so she yarn say;
"SINCE WEY I BE PIKIN I DON DEY DO AM AND I GET PLAN TO CONTINUE DEY DO AM AS FAR SAY I DEY HAPPY AS I DEY DO DEM..."
Omo! See strong passion! I hope say young ladies go learn from dis experience sha... As per who con be her role models wey make her passion strong reach so, she no waste time to talk say; "FOR FASHION DESIGNING, MY ROLE MODEL NA...
![]() |
Lanre Da Silva |
FOR INSIDE MODELING, MY ROLE MODEL NA...
![]() |
Agbani Darego |
AND FOR INSIDE ACTING, MY ROLE MODEL NA... GENEVIEVE NNAJI..."
![]() |
Genevieve Nnaji |
As yoruba dey take talk am "lobatan"(take style ask yoruba person wetin e mean๐)
Las-las, as we wan take style match break ontop d interview with Ene Joan, her advice to upcoming and younger talents be say; "MAKE UNA WORK HARD. DEY CONSISTENT. STAY POSITIVE. DEY UPDATED. IF DEM CRITICIZE YOU, ACCEPT AM CON MAKE CORRECTIONS. FOLLOW YOUR HEART AND MAKE YOU NO FORGET TO ENJOY YOURSELF FOR WETIN YOU DEY DO..."
As una kukuma know say she dey currently contest for Miss idoma 2019 make una show her love and support and still take style vote for her from this link;
https://www.quiz-maker.com/poll2603139x19a24387-74
Incase you need the code to vote for her you fit comment under here and we go provide una with the codes wey una go use vote for ONUH ENE JOAN...
IG @officialenegold
facebook. Enejoan onuh
Better pikin..Continue to dey shine
ReplyDeleteI love her
ReplyDeleteAs eee dey hot, we go take the go.
ReplyDeleteMore grace baby girl we got your back.
Babe we dey your back...d crown na 4u oo
ReplyDeleteNice post. Good blogging
ReplyDeleteBig ups to u blogging mechine for d discovery of our next miss idoma
ReplyDelete