"My name na Oyigbo Blessing. Dem born me on 11th November, 2000. And I be undergraduate for University of Abuja..." Dis babe na very respectful babe and e dey evident for the wey she dey respond even as we yarn pidgin together... On top who she be, she yarn say;
"I be Makeup artist and na Passion wey I get for the trade make me dey pursue career for there..." Hmm if you see wetin i dey see, you sef fit talk say, na one of the youngest if not the youngest Make up Artist wey dey area be dis ooo because dis babe sabi her work well well I no go lie... But anyway, as we move like motor wey nor get break because of time, we con ask her say wetin she want make people remember her for, as she dey pursue dis her career... She talk say;
"I wan make people know me for good, and as the best entrepreneur." For any young babe of her age, wey go talk like dis, e mean say she know wetin she dey do when e concine make up... D thing sef don dey make me wish say I be woman so dat she go make me fine and fresh as she dey... Lol!๐๐☺ Onto how long she don waka for dis make up business, she talk say;
"Na just 3years now..." Omo! 3 years o and she don go far like dis ooo... ๐ฎ๐ฏDis wan na wonder babe oo! Toh, on top who for her field wey she go like to be like, she no waste time to say; "Myself..." Lol!๐๐๐ Blessing really like herself ooo... Anyway as we take waka go front small, na so we ask her say wetin she go wan leave wey people go take dey remember her for... Straight up, she yarn say;
"Good example..."๐๐ฝ๐๐ฝ I reason am, e make sense because if people know say you be betta person, na you dem go wan work with. Dem go even make their friends friends kuma wan work with you... As time no be our friend again for dis corner, na so she tell us say some kind project dey wey she dey inside and she dey learn knitting and na to add to her entrepreneurial knowledge...
Dis babe no wan dull at all and na betta thing be dat... Dis wan mean say she go waka far far for dis thing wey she dey do... But we wey be her fans go only dey pray for her and take style support am when e no far from our hand to do am... I don too talk too much and na here we go wan match break but as we dey do am, make we hear wetin she yarn as advice to other talents wey dey like her; "Be yourself, dey patient, understand ur customer, do ur best, make sure say ur customer dey satisfied, communicate with people, dey humble, respect people cos u no no hu b hu"
Wow thanks.....
ReplyDeleteNne ride on I like your style
ReplyDelete