Tuesday, December 10, 2019

DEM FORCE MAN TO MARRY HIM GIRL FRIEND BEFORE, SAKE OF SAY THE GIRL WEY HIM PLAN TO MARRY BIN RUN LEAVE AM...


Support our correct hustle, click for this link πŸ‘‰πŸ½  http://locinealy.com/17oo  πŸ‘ˆπŸ½
skip the add and continue... God go bless una wella!


...KATE OKEREAFOR...

πŸ€”ONE FRIEND BIN GO ONE WEDDING FOR INSIDE ABUJA ON SATURDAY 30 NOV 2019, WHEN HIM REACH THE CHURCH VENUE,  HIM COME CONFUSE OH,πŸ™„ SAKE OF SAY THE GIRL WEY WEAR WEDDING GOWN, NO BE SHE BE THE ORIGINAL WIFE TO BE, WEY DEM BIN DON INTRODUCE GIVE PEOPLE AS THE WIFE FOR THE TRADITIONAL MARRIAGE DAY.πŸ™†πŸΎ


AS E BE SAY HIM NO UNDERSTAND WETIN HIM EYE DEY SEE OH!πŸ™„ NA THERE HIM COME BEGIN ASK WETIN DEY HAPPEN,🀷🏽 NA THERE DEY BEGIN YAN AM SOME KIND STORIES WEY NA FOR ONLY INSIDE TELEVISION WE DEY SEE AM O.
 TO CUT THE LONG STORI SHORT, DEM SAY THE WFE TO BE, RUN COMOT A WEEK TO THE WHITE WEDDING, NA HIM THE FAMILY OF THE GUY VEX, SAKE OF SAY DEM WAN PROTECT THE FAMILY NAME AS NA ROYALTY DEM BE, DEY COME ASK THEIR SON IF HIM GET ANY GIRL WEY DEM FIT USE REPLACE THE ONE WEY RUN BECOS AS E BE SO, THE WEDDING MUST SHELE JUST TO AVOID PLENTY TALK TALK FROM PEOPLE. NA SO THE BOY COME REMEMBER HIM BABE BEFORE, NA HIM THE GUY FAMILY GO THIS GIRL HOUSE TO BEG HER PARENT MAKE SHE FOR FIT MARRY THEIR SON, DEY EVEN GIVE THE FAMILY BETTER MONEY.


LAST LAST THE GIRL AND HER FAMILY AGREE, WITHIN ONE WEEK TRADITIONAL MARRIAGE HAPPEN SHARP SHARP AND ON THAT SAME SATURDAY THE MAN  MARRY HIM BABE BEFORE FOR CHURCH JUST TO REPLACE THE ONE WEY RUN.

MY QUESTION FOR THIS MATTER BE...
1) AS A LADY, SHEY YOU GO FIT PLAY SECOND CHOICE TO ANY MAN, NO MATTER THE SITUATION WEY HIM DEY OR  SAKE OF THE KIND MONEY WEY HIM GET?

2) AS PARENT WEY YOU BE, SHEY YOU FIT ALLOW YOUR DAUGHTER MARRY FOR THAT KIND CONDITION WEY DEY GROUND, NO MATTER THE KIND PROMISES AND MONEY WEY DEM READY GIVE YOU?

3) SHEY E MAKE SENSE FOR THE CHURCH TO WED THE MAN WITH ANOTHER WOMAN WEY NO BE THE SAME PERSON WEY DEY BIN FIRST DON INTRODUCE AS THE WIFE TO BE?

4) AS MAN, YOU GO FIT ALLOW MAKE THEM PRESSURE YOU TO WED ANOTHER WOMAN JUST TO PROTECT YOUR FAMILY NAME, SAKE OF SAY YOUR WIFE TO BE RUN COMOT LEAVE YOU A WEEK TO YOUR WEDDING ?

5) BASED ON AFRICAN TRADITION, SHEY WE FIT SAY THE GIRL WEY RUN LEAVE THE MAN STILL BE HIM WIFE AS E BE SAY THEY DON DO TRADITIONAL RITES FOR HER HEAD?

6) SHEY WE WAN CALL THIS WAN MIRACLE OR DIVINE ARRANGEMENT FOR THE NEW WIFE NOW TO MARRY HER BOYFRIEND BEFORE?

ABEG MAKE UNA PUT MOUTH FOR THIS MATTER FOR THE COMMENT SECTION.

Abeg no forget to Support our correct hustle, click for this link πŸ‘‰πŸ½  http://locinealy.com/17oo  πŸ‘ˆπŸ½
skip the add and continue... God go bless una wella!

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land