http://legeerook.com/2jei ππ½
π€·π½Legitimate hustle for me, na d main game wey dey bring nuff respect and dignity to any youth wey care to learn. Excuses and procrastination never realy help any youth wey dey focused to achieve any thing wey get value... But we thank God say youths of today don dey embrace legit hustle with d mindset say dem wan contribute to nation building and take style betta their lives... Ontop our waka to discover youths wey dey do legit hustle so dat we go fit celebrate dem, na so we con go jam dis fineπ©π½ babe π©π½wey dey try for her own way to engage inside legit hustle, so dat she go fit make name for herself... Make i no keep una inside suspense... Sharperly, as we dey do am, na she go introduce herself... Oya, make we meet her;
"I be actor and I be Entrepreneur, but I like acting since I dey watch film... So I con start to practice am for 2011. Den, i con go film school for 2017... Na dat time I con become Professional for acting... And I even sabi sing Oo...π" And dat wan na true, because if you hear ChuksJessy sing, you fit start to trip like i trip when i hear her... Lol!π€ But wetin I wan point out to Una be say, she finish school for 2016, where she read Mass Communication... E no do her, she still go Film School where she go learn Filmmaking and Acting and today, she be professional Actor... Omo! I trip for d kind steps wey dis young babe take wey make her reach dis level wey she dey... Dis wan don also prove say, she dey among d youths wey value education and dem dey engage inside legitimate hustle... Chaiπ€¦π½! My mouth too big,π€ but I go try no talk too much... Make we continue with our guest Jessica Livinus aka ChuksJessy... Onto wether e get project wey she don do or joinbody do and wether some kind Nollywood starz bin dey inside she talk say;
FREDERICK LEONARD (NOLLYWOOD ACTOR) |
MERCY MACJEO (NOLLYWOOD ACTOR) |
"I go like make am for dis field and start to produce my own films... " Wow! See correct babe with big dreams... My respect for dis babe don increase oo!π Toh, when we con ask her say who be her mentor(s) or if people dey, wey she wan be like, she talk say;
CHACHA EKE FAANI (NOLLYWOOD ACTOR) |
"My advice be say make dem dey focused and prayerful. All of us know say nothing good dey come easy... If e no betta today, e go better tomorrow!"
E con be like say make dis session with ChuksJessy no end but we gats end am so dat d π«flightπ¬ wey dey wait for her go carry am go her next point of duty... But we know say you go was chook mouth on top her matta. You fit do so under here and make you also know say you fit reach her on top her social media handles wey be:
FB: chuksjessi
IG: chuksjessi
Click here to support our legitimate hustle ππ½
http://legeerook.com/2jei ππ½
You we be successful in all you do ,u re going places nothing we bring u down ur dreams and aspirations we come to pass...choco
ReplyDeleteGo and prosper you we succeed, oo from Hprince..choco
ReplyDeleteCoco and choco and kwunu,una well-done
DeleteMy blessings to you dear,I pray for better days ahead,much love from me,still heart you❣️
ReplyDelete