Tuesday, January 7, 2020

Una welcome back!!!


Oya na new year we dey so oo, no forget say you fit support our correct hustle by just to click ontop here πŸ‘‰πŸ½http://pladollmo.com/1W3MπŸ‘ˆπŸ½... God go bless you nyafu nyafu for 2020!


Happy 2020 to all of una wey make am oo! As new year don reach so, Inside plenty plenty resolutions, celebrations and some kind anticipations, I dey always take some kind quiet moment, to take style look back. So that i fit see both my achievements and opportunities wey I miss, both my work and personal life and both my highlights and low points, make dem sink inside me well well so that I fit readjust.

E dey very easy to start to feel one-kind one-kind and con dey dwell ontop the things wey bin no go according to how we plan am and somehow I dey feel say na normal thing because na human nature.

That na the reason why we dey exist especially for this blog because e dey give me some kind small time every now and then to take style remember the kind betta people wey i bin meet especially since this blog start 1 year ago.

After this one year, wey don include plenty life changing moments, I don already dey wonder how year 2020 go match up to the greatness? But as we all bin dey try for our own small small way to  dey more present throughout 2019 and with hopes and wishes for our minds for the year 2020, make we no forget say Nigeria na we own, make e no kpafuka. Make we join hands to make am betta, because no place be like our home...

Una welcome back!!!


Oya na new year we dey so oo, no forget say you fit support our correct hustle by just to click ontop here πŸ‘‰πŸ½http://pladollmo.com/1W3MπŸ‘ˆπŸ½... God go bless you nyafu nyafu for 2020!

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land