![]() |
Police pipo don arrest one suspected armed robber wey steal one car and been dey escape go one neighboring country .
The Katsina State Police command don confirm the arrest of this car theif theif, dey been catch Mohammed Sani wey dey 28 years old with one silver color Toyota Highlander as him won cross enter Niger republic.
Dem been catch Sani wey been dey live for Akwanga Local Government area of Nasarawa state around 8.30 in the Morning with the help of one good Samaritan.
The police talk talk person for inside the state, Superintendent Isah Gambo confirm am for one of him talk
Hear As him take talk :
"As we dey do our investigation , the suspect confess say him been rob and even collect the car from the person for gun point for inside Jos, plateau state"
"We still dey shine eye for the matter." Na so police take talk.
No comments:
Post a Comment