Bishop defrauding in Godβs name arrested by EFCC...
Deborah Odoekwu.
You see when some pastors dey use their
church mind dey tell people make dem sow seed, some other people go dey use the
opportunity make dem take chop people money. As I dey talk dis one, dey don The
Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don gbab one Bishop for Delta
State sake of say im dey use God name dey do people 419.
This Bishop weyim name be Giniko Obi, n aim
be the founder of Beloved Gideon foundation for Agbor wey det Delta state. E
even get their branch for Bayelsa o, Onitsha, Lagoso, Port-Harcourt o and even
Abuja. We hear say dem arrest am sake of say imbn do plenty people 419 and the
money wey im don collect don enter millions of naira. Im dey collect their
money come dey tell dem say e dey help dem to fight poverty.
Giniko Obi wey talk say im no dey do 419,
still talk say im just dey do God work and im dey try help the people make
poverty run commot for their life, say im just want make people no dey suffer
as God too no want make dem suffer, n aim make am go do this tin wey resemble
wetin MMM bn do plenty people dat time.
This bishop wey dem gbab come dey claim say
im get diploma for theology, say im dey too holy to dey do that kin tin. He
come talk say im just commot from Agbor go agos so that im go fit expand the
business but the people wey bn put their money inside no come gree for am.
Im come talk say im don write some books, don
organize seminars and workshop dem so that dem go use am train people on how
dem go take make am for this life, say dem go tell the people say if dem
register with #10,800 dem go give them #15,000 and if dem register with #18,000
dem go give dem #23,000. Im talk say imbn get about 30,000 people wey register
and im dey pay dem, say supposing dey allow am make e go do the training wey
imbn wan go do for Lagos, im for don pay dem their money.
One of the people wey bn register for the kin
tin wey her name be Janet amakOkafor talk say this Bishop bn come tell dem say
im from Gideons International wey dey America, say this man even kneel down dey
swear with Bible say im come from America. She kuma come register with 310,800
and she come get #15,000. Na so im come use dem do customers o. she come talk
say she as she dey even bring plenty people make dem come register and if you
plus everything wey dem take register e go pass #5 million.
Another person wey dem scam, wey her name be
Bessie Nwadibire wey be 67 years old, come talk sayb this Bishop bn don dey do
konikoni since when im start dis business. She talk say when him bn come market
he come dey share drinks, dey dash people money wey go reach #50,000, say poverty
don too much for Nigeria. She come talk say she just dey pray make im give am
back her money.
As she dey happy say EFCC don gbab the
Bishop, she come talk say before dem arrest am, she with all the other people
wey bring people for the business come dey hide sake of say the people wey dem
bring for the business talk say dem go fit kill am if she no bring back their
money. She say the money wey those peole put go pass #8 million naira.
According to the EFCC people, dem go soon
carry the matta go court.
Make una shine your eye plus your brain o!
people no dey smile again. E no dey hard for people to scam even their family
members o. so open for where you dey chuk your money.
No comments:
Post a Comment