Blind gospel singer accused of defiling his tenantβs daughter... Deborah Odoekwu.
Na this kin tins I no dey quick understand.
How the man take catch am sef? Me sef I don tink tire. Make I give you this
chuenchuen so that you go follow me tink. No be only me go tink this one.
Hmmm, we just enter our Nigeria A-Z on a
normal level, n aim we come match brake for inside Edo State. Na for that Edo
state n aim we hear say one 49 year old blind man wey dey sing gospel song, wey
don rape im tenant pikin. Police con visit this man sake of say im rape this
girl wey be 9 years old for im house wey be house number 9 for Isidahomen
street wey dey Ekpoma for inside Edo state. This man wey im name be Anthony
Okhiria come talk say im no rape anybody, say musician wey e be and im dey sing
Christian music. Anthony Okhiria talk say im senior brother n aim get the house
from their papa but im dey stay for Lagos so im brother come put am in charge
of the house as im no dey stay for Edo state.
Im talk say the mama of this girl dey stay
for the house together with her four children, say na their church dey pay their
rent for them. One day n aim the woman come tell am say their church say dem no
go pay rent for am again and she no wan pay am im. From wetin the man talk,
this woman come dey try seduce am but im no gree. Na im she come meet am one
day, come dey tell am say she dey feel say im like am but im come come tell am
say, no be she go tell am whether im like am or not. The man still talk say
this woman children dey come im room dey do nonsense nonsense tins, say if dem
come im house, im dey pursue dem commot. Im come report give the woman say im
no like how her children dey come im house dey do nonsense, but the woman come
tell am say, na play her children dey play with am. Im come tell am say, e no
like dat kin play o because na Christian him be o.
According to wetin the man talk, this woman
pikin wey dem talk say im rape, dey come im room sometimes when e dey sleep,
come dey touch im legs, say even the girl mama dey come inside im bedroom. say
e even reach one stage wey im go dey rob cream for im body, this woman go just
enter imparlour, see say im dey naked but instead make she go, she go just dey
there dey look am.
Im talk say na one day o when this woman just
come tell am say her daughter wey be 9 years old come tell am say im dey sleep
with am, say as she talk am, im just shock.
Las lasim come talk say im no like as im dey for this kin problem,
say im no rape am and na lie wey dem dey lie for am
Hmmm. Tohuna go join help me tink this one
cos my brain don knock for this one. I don turn to Tinkerbell where I dey tink
the matta. I no know who dey lie and I no know who dey
talk true. Na report wey dem say make I do. The thinking part, na you go do am.
No comments:
Post a Comment