Man
dressed as woman caught with pants in female hostel in Ogun State. ..
Ayim Raymond
Ayim Raymond
Hennnnβ¦.hennnn..hennn, like play like play
this pant issue don dey pass hand ooo, e start from south-south now ie don
dey rush go south-west.
Yesterday dem gbab one man weh dress like
woman as him go thief plenty pants for one female hostel for the Ogun State
collage of Health Technology for Ilese-ljebu.
According to report, the suspect been go the hostel
say him dey sell Ice Cream, but wen him comot, the bag weh him cari come big
pass the way weh him cari am enter the hostel, na this one come make the security
guards to search am, come see say na pants full inside the bag.
As them gather am, na him them com still see
say na man, him just dress like woman so that him mission go dey easy.
Dem later hand over am to police for beter
investigation.
No comments:
Post a Comment