Wednesday, January 16, 2019

Dem Don Catch One Fake soldier inside Ebonyi...



From Deborah Odoekwu...

I no know why some people go use their own hand dey give theirself problem. Trouble go just dey im own, you go just carry your two left leg come dey find am.
Now for Ebonyi state, dem don gbab one 25 year old man, wey im name be Moris Mbam, sake of say im dey parade imself as soldier when true true, no be soldier im be o.
As dem carry am commot for me and my fellow chuen chuen people, Muhammed Mustafa wey be the Commissioner of Police for Ebonyi state, talk say dem gbab this moris Mbam wey come from Izzi Local Government area for one bank wey dey Enugu as im dey try collect the money wey im don get from the kin koni koni work wey e dey do.
According to Police Oga wey dey for ebonyi state, this man wey dem gbab so dey give many many people wahala for that place as im dey use im fake army uniform dey collect people money and their tins. For 25 December last year, this Mbam come use this im style come collect some people house wey dey Abakiliki, say im come collect #40,000 and one Tecno phone form dem after im keep dem for like two hours for there.
Oga Mustafa, wey be the Commissioner of Police for Ebonyi state, come talk say this man don dey hold people, dey put fear for their body say im be soldier . n aim police dem come hear wetin dey happen, come arrest am. He come talk say even before dem arrest am, dem don dey find am since before dem come finally catch am come arrest am for 11 january, 2019. Im still talk say e don tey wey Mbam don dey carry im self as Soldier before some police people wey dey division A wey be the Central Police station for Abakaliki, come arrest am, say as dem dey shout dey ask am question, n aim e come confess say true true im do all these tins.
This man come dey talk say, im from Okpuitim community wey dey for Izzi local government area for Ebonyi state, say im no be correct soldier o, say im just dey carry imself as soldier sake of say im bn sell one phone wey be #10,000 to one person last year but the person come give am #7,000. So as im come back for November, im come ask am make e pay im balance of #3,000 but the man come talk say e no dey pay anything. Im come go meet the person landlord come tell am say make im tell the person say im be soldier, say make e tell the person make e pay am im balance if not kasala go burst o. Mbam talk say im tell this man say im be soldier so that the man wey dey owe am go quick pay im balance, say im never ever use dis soldier tin before, say na engineer wey im be o.
Hmmm, anyways, the Oga of Police for ebonyi State, Muhammed Mustafa don talk say dem go carry am go court very soon.
Oh oh…dis one wey dem don dey use uniform lie, abeg o take am easy. In fact, no even tink am because when dem gbab you, dey no go do you sofree sofree o.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land