Wednesday, January 16, 2019

One Revenue Agent Don Go Beat One Catholic Priest To Coma Because Of N500 For Abakaliki Rice Mill..



From Deborah Odoekwu

I don see say any time I enter one state make I get chuen chuen, another one go just hold me for there. You know say chuen chuen no dey pass my ear like dat.
So, we come hear say dem beat one reverend father tinka tinka sotey im land for coma. Na im we say make we go chuk ear for the matta.
We hear say one of these area boys wey dey do β€œha! Oga, anything for the boys” don beat up one Catholic Priest for Ebonyi state, wey im name be Rev. Fr. Mathew Orie, for Abakiliki Rice Mill Company, on Monday evening, sotey this reverend father enter coma.
From wetin we hear, the thing wey make this agbero beat am like dis be say the reverend father no gree roger am with #500, no be say im suppose pay am dah money o. we still hear say this reverend father dey the accident and emergency unit for Federal Teaching Hospital Abakaliki (FETHA), dey fight for im life.
From the chuen chuen wey we get this area boy bn standa for the gate dey collect money wey im no suppose collect from people wey dey enter. This Rev. Fr. Orie, na the principal of Girls’ Technical College for Agba wey dey Ishielu Local government Area for the state. Na im e come say make im go the rice mill go buy rice for im students and from wetin we still hear, im pay all the money wey im suppose pay to collect the rice but as im reach gate this area guy wey dem still dey find just block am come tell am say im must settle am before e go fit carry the bags of rice commot for the place. Toh the reverend father bn wan pay am the #500 naira before some other area boys wey dey there come tell am say make im no pay anything say im don finish to dey pay for everything wey e suppose pay for.
Person wey dey when this tin bn happen talk say as dem tell the reverend father say im don pay everything wey im suppose pay, im come decide to carry the tins wey im buy commot for the place, come say e no dey pay the area boy. Na there this area boy just descend for this reverend father come dey beat beat am sotey the man come enter coma. If you no wetin coma mean. Coma na dah time wey person never die but im still no dey alive. Im just dey the middle.
So as e take concern this matter, this person wey dey when e happen still talk say, na some police people wey dem call, na dem come carry the reverend father go hoispital where he dey still collect treatment.
The Police talk talk person wey dey Ebonyi state, Loveth Odah come confirm say true true this thing happen. She talk say dem don carry the motorcycle wey this agbero abandon as im dey run. Las las, she come say dey don carry the matta for head, say dem go make sure say dem find the guy, come gbab am.
Hmmm
Some people just no get fear at all for God. You see say the man na reverend father, you come still get mind to attack am. Hmm na God get your case! I just pray say this reverend father go quick commot from the comma wey im dey so.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land