
Hmmmm some people beauty no be here ooo... See how God take him time package some ladies like Miss Joshua Tosin C. wey wan use her beauty touch lives so that Nigeria, wey she come from, go better... Na this kind one, wey we dey call, "Beauty With Brains"... Make una meet the Beauty Queen wey be Miss Geo-Political Zone Queen For Face of Arts Beauty Pageant wey na Black Giant Signature organize am...
Ontop her sweet voice she say, "My name na Joshua Tosin Christiana...My papa put me inside my mama belle, she con born me 18th December..." O boy this Beauty Queen sabi tear pidgin ooo, thesame way she dey tear English... She no stop there ooo... When we ask her about her educational background, with humility, she talk say; "I finish from city college of education, Gurku, Abacha Road-Nasarawa State..." From the way wey she dey smile dey talk, you go see say this one know wetin she dey talk...
According to her; "I like dey read book... My philosophy be say; Make you no expect anything and you no go dey disappointed...' When we ask am about food, likes and dislikes, trust this natural beauty, she shout; "Chee! I like food well well, and people wey dey straight forward, I dislike pretenders ooo..."
Toh, to the real koko about who she really be; "I just win Miss Face Of Arts South West Nigeria... For face of art contest 2018/19..." Na so i shine eye con ask; How you take reach there? "Hmmm! I get there through my mother encouragement and support ooo..." Woooow! See Mother'd love na... As e con be like dis, we know say this kind person go one use her Crown do better thing, especially to make her Mama proud. So she talk say; "I hope to achieve better akpala kpala way I fit use source for widows and their children.." Una see why I say this one na "Beauty With Brain." Onto her final-final tori, especially to people like her, she say; "My final message to youths be say...'Nothing good dey come easy, so any little opportunity way dem get to use explore, make them use am well well...Thank youπ"
No comments:
Post a Comment