Wednesday, January 30, 2019
Na wa o! Police rescue man from mob wey wan lynch am, after him stab one girl to death for Owerri, Imo State
(From Deborah Odoekwu...)
Ewoo
Katakata don burst for Imo state as people join beat one man rango rango. The story wey follow the matter be say this man wey dem beat so bn use knife take chuk one girl sotey she die for Owerri wey dey inside Imo state. This people wey gather am come dey beat am for don kill the man if to say Police no show for the place o.
This man so, some people talk say im get sko sko for head, others come talk say na yahoo yahoo boy wey im be, wey wan do money rituals. These people come catch am, come hold am sake of say im use knife take chuk one young geh till she die for Douglas market wey dey Owerri for Imo state.
hmmm dem beat dis man tink tinka nd dem almost use fire take roast am before Police dem bn show for the place come handle the matter.
As dis one come dey happen, n aim people for internet come dey drop comments. One of them wey be Successman moneyman come talk say β abeg, e get yahoo yahoo guy wey get sko sko for brain?β another person, Vivian reginalds come talk say βhe go sha rotten for prisonβ
Hmm wetin this man do, no be am at all o. but even tho make una no dey take laws into una hands. We get police, army, DSS dem wey una go fit carry dm go when something like dis, abeg. I hope say our Ogbonge Police people go handle the matter well well
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment