From ALI INA...
The Niger state police command don arrest one 31-year-old armed robbery suspect, Adelowo Adedayo, because say, him kill one of him victims wey be, Abdullahi Liman, con bury am for one shallow grave behind the APC quarters for Suleja inside Suleja Local government area on January 16th.
Adelowo wey lead the team of police detectives go the shallow grave on Tuesday January 22nd, talk say, him kill the victim so that him go fit steal him property wey include, set of chairs, LG plasma television, mattress, three pairs of shoes and two bags of clothes. Hear as him talk am,
βI don dey plan to steal from him house for the past six months; but unfortunately, the day wey I go there, him con dey for house and the only option wey I con get na to kill am. Liman house been dey well furnished and I been want some of the property wey him get; but as I con meet am for him house, I kill am, so that him no go con expose me to people.β Na so him talk
Confirming the incident, the state Police Public Relations Officer, Muhammad Abubakar, talk say the suspect confess to the crime as dem dey interrogate am and say dem go charge the suspect go court very soon
No comments:
Post a Comment