Wednesday, January 23, 2019
Court Say One Man Go Die Because Say Him Hack Him Neighbour To Death Over Generator Smoke...
From Olu Alvin...
one Lagos State High Court, for Igbosere, don sentence one 31-year-old man, wey him name na Ibrahim Tijani, to death by hanging, because of say him kill him neighbour because of generator wey dey comot smoke.
The convict, wey dey live for one uncompleted building with the person wey die, dey live for Okun for Ajah area for Lagos, been talk say him no dey guilty of watin them say him do.
The Prosecutor, wey be Adeniji Kazeem, wey also be senior advocate of Nigeria and Attorney General of Lagos State, been tell court say Mr. Tijani, wey be 31 years, been kill Bashorun Okan-lawon, wey be 57 years old, with machete arround 2:30 in the morning.
Hin talk say this offence contravene Section 221 of the Criminal Law of Lagos State, 2011.
During the trial, the 16-year-old pikin of the man wey them kill, wey him name na Adeola Okanlawon, tell court say the accused use cutlass kill him father, after him father complain to the accused say the smoke wey him generator dey comot dey disturb am.
According to Adeola, him say him papa been ask the convict say make him change where him put him generator so the smoke no go dey enter him room, but him no gree, na him quarrel start, fight come bust.
Adeola talk say as the convict go carry cutlass, come cut cut him papa, him say him beg am say make him stop, but say him no gree hear.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment