Tuesday, February 5, 2019

Backyard Wahala; Landlady dey warn slay queen about her "backyard ", say dem dey distract her husband




From ALI INA...

One Nigerian landlady don warn one of her well-package tenant say make she no dey wear  trousers within the compound, say her backside dey distract and confuse her husband.
The lady, wey we discover say her name na ID James, share the warning ontop her Facebook timeline.
ID James talk say the landlady almost dey cry as she dey give am the warning.
She con talk say she don kukuma stop to dey wear trousers around the house o, so that she go fit avoid to break another person marriage.
See as she take talk am;
β€œMy landlady almost cry yesterday when she talk say,  make I stop to dey wear trousers anytime wey I dey inside her compound, She say my backyard dey always distract and confuse her husband. Toh, As a respectful girl, make I just jejely go start to wear my skirts ooo before person Papa go die o…” Hehehehehehe Chai!  From frypan to fire... No be only skirt,  na village wrapper...

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land