From ALI INA...
One nine-year-old girl wey dem identify as Hassana Aliyu wey dey stay for Kasarau Yamma quarters inside Dutse, for Jigawa State, don lost her life after she fall inside well.
The Director, Jigawa State Fire Directorate, Alhaji Ahmed Danyaro, tell the News Agency of Nigeria NAN for Dutse on Friday say, the incident happen around 1:30pm on Thursday.
Danyaro talk say, βNobody fit talk how the girl been falll inside the well, as we just receive one call like that say she been don fall inside well for her Parent's house.
βAs we receive the information, na so we sharperly send our rescue team, wey con bring her commot as she dey unconscious and na later when we carry her go hospital, dem talk say she don die.β
Him add say, dem don carry the girl dead body, hand over to her parents so that dem go fit bury am...
The director still con advise parents, wey get well for their house, say make dem try to raise the height of the well and make dem make sure say dem provide better covers for them so that e go fit protect their children and wards.
According to am, the agency go continue to sensitise the public ontop how dem go fit to use well for their house...
No comments:
Post a Comment