Tuesday, February 5, 2019

Islamic cleric, three others wey dem arrest with human skull for Ogun State


From DEBORAH ODOEKWU ...


Wetin person no go just see for this world ehn
Hmmm e don happen for Ogun state where we hear say dem don arrest one Alfa together with three other people sake of say dem catch dem with human being skull.
Hian! I no know wetin go concern alfa with human being skull. Anyways, some Police people wey dey for Agbara Division don carry two of these suspects; Teslim Ayeniromo wey be 45 years old and Sunday Kolade wey be 35 years old, go Kofedoti for Ogun State.
The chuen chuen wey we get for this matter be say as dem dey do one searching searching na im dem find this human being skull for inside the bag wey one of them been dey hold, na so dem come quick carry them go police station.
As the Divisional police Officer, CSP Adegbite Omotayo dey ask dem serious question for the station, na im dem come talk say na one Michael osanyinbi, na him give dem the kin skull, say dem dey carry am go one Alfa before police dem come gbab dem.
The Police talk talk person for ogun state police command, DSP Abimbola Oyeyemi wey confirm this arrest come talk say these suspects dem bn carry dem go the house of the man wey give dem the skull. This man kuma come carry the police go the Alfa house. DSP Abimbola come still talk say the Alfa don confess say true true im bn request for the skull wey Michael Osanyinbi talk say he go bring for am for #25,000 plus #1,000 wey im go give the bike man wey go bring am come im place.
Las las the alfa come talk say him need the skull for one ritual wey im no gree talk wetin e be. As e be so the commissioner of Police for the state, CR Ahmed Iliyasu don give order make dem transfer the matter go the Special Anti-Robbery Squad so that dem go fit chuk eye well well for the matter.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land