Tuesday, February 5, 2019

Chai! Mother in-law die after her daughter in-law pour hot water wey dem mix pepper ontop her



From DEBORAH ODOEKWU... 

Heeyyy! Some people no dey fear face again o! but this one bad oo kai!
Na so one woman wey go dey dah kin 40 something or fifty something don die as her daughter-in-law use hot water wey mix with pepper come pour on top her body. This woman, Mrs Rebecca oladosu bn die after her daughter-in-law, Taye lamidi bn plan with Basirat lamidi and one other person to pour am hot water wey get pepper inside.
According to wetin police people dem bn talk basirat and Taye attack this woman for 30th October, 2018 for her house wey dey Okeyelu village, Ilie for Olorunda Local Government wey dey Osun state. From the chuen chuen wey we hear, dem arrest these two women immediately this tin bn happen and since then, dem don dey enter commot, enter commot, like dat like dat for one magistrate court wey dey for this osun state so.

As dem resume the case for this Friday wey just pass wey be 1st February, 2019, the Police prosecutor wey be Inspector Muslim Jafani come talk for court say Mrs odunsanya wey don dey hospital since this tin bn happen, don die. He come tell the court say make dem commot the judgement wey dem bn give these women before, say make dem change am to two new crime wey be felony and murder.
The court come change am to two count charge of felony and murder wey dey against section 516 for the criminal code, vol 34, laws for Osun state of Nigeria, 2003.
Na wa o… I know say some mother-in-law dem no too get good character but why you go take am far like dat na?
Sha police and court dem don handle the matter...

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land