Wednesday, February 20, 2019

Chai! Bricklayer allegedly kill him co-worker because of N47,000. ..

The Suspect 

One bricklayer wey dem identify as ThankGod Emmanuel, wey come from Sauka-Kahuta area of Minna, Niger State, dem don arrest am, sake of say, him allegedly kill him co-worker because of N47,000. Chai!
The suspect, been kill one Tita Komla, of the same address, with digger. And na one team of policemen wey dem attach to Tundun Wada Division, na dem catch dis man.
We hear say Komla brother, wey be Tete Joe, of Katampe, inside Abuja, been don earlier report say him brother been dey work with the suspect for him construction company wey dey for Sauka-kahuta.
Him claim say the suspect been call am for phone to notify am say Komla been don die and na some unknown persons na dem kill am…
We hear say the suspect been engage him victim for one kind Jackie chan physical combat like dat, before him con kill am with digger, con theif him N47,000, before him con thruway him body inside gutter.
Emmanuel talk say him kill Komla with digger so dat him go fit take him money.
Him talk say: β€œKomla been no know say I been wan theif him money. I kill am so that nobody go know say I theif him N47,000. I use digger to injure him head, na so him die instantly.
β€œI been no suspect say the police go identify me as the person wey kill am. Well, e dey very unfortunate.”
Confirming the incident, the state Police Public Relations Officer (PPRO), Muhammad Abubakar, talk say the suspect been confess say na him committ the crime.
Abubakar talk say the suspect been injure the head of him victim and run away with him money. The PPRO add say dem go carry the suspect go court soon.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land