Wednesday, February 20, 2019

See As 'Negligence' Of Asokoro General Hospital Abuja, Don 'Cause The Death' Of Health Advocate, Kafayat

Kafayat Abdulazeez




Young Nigerians don dey accused the Asokoro General hospital of wetin dem say na negligence, wey don lead to death of one Kafayat Abdulazeez.
Kafayat Abdulazeez, wey be 25-year-old lady, been no dey feel  well on Valentine’s Day. According to Yusuf, wey be her colleague, she been go Asokoro General hospital where dem been admit her, and the doctors con diagnose say she get pneumonia. Wey be when cold don catch you till e break you down…
Yusuf talk say, after the initial treatment, she con get her strength but "painfully, the following day, wey be Friday, her situation con worse and the hospital no longer con dey as responsive as dem supposed be".
According to am, "Mobile oxygen, wey dem been suppose to use ontop her, dem been no use. Doctor con prescribe drug wey dem go give am, but the nurses no give the prescription to the family until a day after. By then e don dey too late."
We hear say the late Kafayat be the Co-founder of Al-imran Islamic Foundation. And before she die, she be health advocate.
Yusuf talk say, the late Kafayat been die due to the carelessness of medical practitioners and the unhealthy health system. 
Him say, "dem no fit call dis wan medical mistake,"
"Say e be clear case of lack of value for person life by our medical practitioners.. Her family and friends been dey beg, dey even cry but dem no show any pity. One patient for the hospital sef con call some doctors dey beg dem on her behalf say make dem just treat am, but all her efforts no produce any result."
Yusuf con beg the government authorities say make dem hold those wey dey responsible for this kind acts of negligence, wey don continually lead to some kind unavoidable deaths dem, and make dem bring dem to book.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land