Friday, February 1, 2019

Chai! Pastor Why? Ehn! Why?




From Ali Ina


Ha! Pastor Why! Ehn, Pastor Why! Anyway make I no talk too much incase you dey wonder which Pastor I dey talk too like that… Hear am…One Mapo Customary Court For inside Ibadan, on Thursday wey be yesterday don scatter one 18-year old marriage between one Grace Adekunle and Pastor Adeyemi Adekunle because of wetin dem say na abandonment, irresponsibility and impregnating church members. Hia! Again I dey ask, Pastor why! Oh!
Anyway, for her petition, the claimant, wey be school teacher been don tell the court say her husband, wey be pastor, been abandon her, con committ adultery wey mean say him go do touch-touch with him female church followers. Ontop her vex, she talk say:
“Firstly, Adeyemi never show any form of responsibility ontop any of the five children and me since wey him become pastor some years ago.
“Adeyemi no dey even make provision for their feeding or even send them go school.
“One message wey Adeyemi dey always repeat for my ear be say, make I no expect am to send the children go school because him na poor man of God.
“Him also talk say, shey I see am as pastor before I agree to marry am.
“Because of this, none of our children wey dey between 8 and 16 dey any school as we dey talk.
“I don spend everything wey I get ontop the children and I never see any progress since.
“The worst part be say, Adeyemi don dey do touch-touch with female worshippers inside him church and him don even impregnate two of them,” Na so she talk.
The respondent kuma, no con dey for court when them call am make him respond to the allegations.
 Chief Ademola Odunade, wey be President of the court con rule say, e don dey necessary tyo scatter their marriage because love no dey between them again… But him still talk say dem go grant custody of the first four children to Adeyemi while the last one go remain with Grace because of him age, plus him go dey pay monthly allowance of N5,000 and him go dey responsible for the pikin education and other welfare…

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land