Friday, February 1, 2019

"Na me be d present Queen, Face of Arts Nigeria 2018/2019"... Miss Ocheja Umekwuojo Blessing


"Beauty", as we know am,  get different levels. Even sef, e get different sizes and shapes... And this na one great requirement for Beauty Pageants b4 dem go crown person as "Beauty Queen"... Na so, her Beauty + talent + plus + brains + betta waka don make Miss Ocheja U.  Blessing become another Beauty Queen wey don dey make News now, no matta how anybody think am or talk am... But make we leave matta for matthias, follow me as we begin betta tori waka with The Face of Arts Nigeria...

"My full Name na Miss Ocheja Umekwuojo Blessing... My mama carry me for belle sotey she born me on the 14th of June 1997 wey be Saturday..." Chai!  The way wey dis Beauty Queen dey dish out pidgin ehn,  no be here ooo... Make we hush,  she still dey talk. ... "I dey 400level for Kogi state university, Ayingba and na physics I dey do...." Chineke! So physicists dey fine reach like dis... Ha,  c wonders o! "I dey always like to dey hear jams, dey dance and I dey like travel wel-wel..." This one no be lie,  if you see how dis Beauty Queen dey scatter ground ehn, you go know say Kaffy own na play..." (no be me talk am o)
When we ask am wetin be her Philosophy in life, she no waste time to say; "for this life my philosophy be say, make you do wetin go make you happy evrytime because na only one life you get oooo (YOLO).... "Yolo"? No ask me o!  If you see am,  make you ask am because her pidgin dey solid,  no be small thing..."
She still con talk say; "as you see me so ehhn, I like enjoyment die and I like people wey get free mind..." Na so!  This Queen na correct babe,  I no go lie... Ontop her Dislikes she say; " I no like people wey dey selfish and person wey dey carry people for mind...." You sef wey dey read, no carry am for mind o,  if not "OYO" na your case o!

Presently, she con tell us when we ask her wetin be her office name as per Beauty Queen? With her straight smile and correct set of teeth she say; "na me be d present Queen, "Face of Arts Nigeria 2018/2019" E remain small I for forget say na work I dey but sharperly I retrace... Lol!  Make we continue jare... How u take reach where you dey now? She talk say: "Na with the support of my Family and people wey like me, I take reach that level..."
Ontop her Achievements So far, she yarn say; "For my own small way I don try inspire people say them fit achieve goals for this life..." But she no stop there as she still get hope to achieve something with her office...  She say; "I go make sure say I join hands with people and together we go put better smile on the faces of people wey get disabilities...." Shey you see say I no lie when I say dis Queen na correct babe!

For her Final Message to youths, she still no waste time to talk say; "my brothers and sisters abeg make una no allow anybody deceive una say Nigerian youths dey lazy, make una try put una best into wetin una dey do and the sky no go be una limit but una starting point... THANK YOU!!!

2 comments:

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land