Wednesday, February 6, 2019

Chimoooo!! See As One Man Commit Suicide After Him Attack Him Wife With Acid For Anambra



From Deborah Odoekwu.... 

Heyy chimooo!!
How people dey take get mind these days sef?
Ha! Some kin tins wey person go just hear go fit make ear bend o!
Na wa oo
Chai!  The people wey dey stay for one community wey dey Anambra state don shock o as one man attack im wife with acid hmm, before im come kill imself.
This man wey attack im wife with acid come carry the acid, come drink am so that im go die.
This kin sad tin bn happen on Monday wey be February 4thfor Mbaise Nsugbe for Anambra State.

From the chuen chuen wey we gather, dem say this man bn attack im wife with acid sake of say she build house, come use her son as next of kin. Say as im find out about am, im body come dey do am somehow, he come dey vex, na im he come use acid take finish the woman for her body till she come die.
As im kill am finish, he come carry the acid, come drink am, come die.
Which kin yeye jealousy be that one ehn? If person build house come put im son as next of kin, e bad? Hian! Some people sha get serious sko sko for head! I just dey pity the poor boy wey don loose im parents and I dey hope say the soul of this woman go dey at peace where she dey.

Ha! The matter weak me o, na so this woman just die..hmm

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land