Wednesday, February 6, 2019

One Man Don Stab Neighbor To Death Because Him Bin Dey Play Loud Music For Ebonyi



From Deborah Odoekwu...

Police people dem for Ebonyi state don arrest one 50-years old man wey im name na Cyril Oko, sake of say him use knife take chuk im 25-years old neighbor wey be Peter Nkwuda till im come die. This thing so bn happen for February 4, 2019 and according to wetin police dem talk, this man wey die and the other man wey kill am bn dey stay for Oroke Onuoha wey dey for Ebonyi Local Government area for the state,
Hmm
Kasala bn burst when Peter start to dey play music from im room, come high the volume well well sotey all im neighbours dem start to dey complain and from the chuen chuen wey we hear, this Cyril wey kill am bn go beg am make he reduce the volume of the music wey im dey play but Peter come refuse say im no go reduce anything. Na so quarrel take enter fight o! Cyril come vex enter im house come commot with knife, come use am take stab Peter. Na so peter just die for there.
Them come carry the matter go Kpirikpiri Police station. Na for there the police people dem come send their people make dem go the place go arrest Cyril. As we reach the ebonyi state Police Public Relations Officer, wey be DSP Loveth Odah, she talk say true true this tin bn happen, say after dem don finish to dey chuk eye for the matter, dem go carry Cyril go court.
Na wa o. anyways make I no too talk for this one, make I leave the talk talk for you ...

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land