Saturday, February 16, 2019

Confusion As Residents Beats Pregnant Woman To Death For Alleged Witch craft

 From ALI INA... 


 The Commissioner of Police for Adamawa, Mr. Moses Jitoboh, don confirm the arrest of five suspects because say dem beat one pregnant woman to death because according to dem, she dey practice witchcraft. Jitoboh tell talk-talk people inside Yola on Saturday say the 32-year-old woman, Ayina Afraimu, wey come from Falu village inside Guyuk Local Government Area of the state, and dem been kill am with sticks and rope. According to Jitoboh, the Suspects wey committ this offence na; Abraham Adamu, 18, Malachi Yilafane, 35, Thomas Aji, 54, Zakariya Chorum, 56 and Miss Newana Ilihal, 20. Him also add say, dem go charge the suspects go court for wetin dem call culpable homicide, criminal conspiracy, and defamation of character. Make we no forget say, Witchcraft or witchery na the practice of and belief inside magical skills and some kind abilities dem wey person or people dey exercise. But for Africa, dis one naim we dey call β€œjuju” Adamawa

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land