From Ali Ina...
The Katsina State police command, don arrest Nine suspects sake of say dem do gang rape and turn two underage girls into people wey sabi this touch-touch business pass normal... Parading the suspects for the police headquarter, the talk-talk person, SP Gambo Isah identify the suspects as Ali Isah, 68 Years, Ayuba Sada, 65Yrs, and Danjuma Saleh Galadima, 62 Yrs.
SP Isah talk say, others include, Ibrahim Saβidu Zaki (46Yrs), Salisu Dahiru (46Yrs), Ibrahim Mohammed (38Yrs), Yahaya Salisu (40Yrs), Shehu Umar (55Yrs) and Ibrahim Ummaru (45Yrs). Kai! All of dem na old men fa!
The suspects, according to police dey for prison custody as dem don charge them go Senior Magistrate Court, SMC 5 Katsina State for the offence of rape and conspiracy and the case dey come up by February 28th, 2019.
The incident been happen when one of the rape victim been dey sell something for road, because say she been lose her father, and her mother con get skoi-skoi for head. She pushed am commot for their house, naim she dey street dey try to survive. Even her uncle no show little or no care at all and na that one con lead her to dey ask for food from her clients and sell her body too. We later hear say when the mother skoi-skoi con disappear meaning say she regain her sense. Naim she con report the case for the Divisional Police headquarter, Ingawa. Say one Ibrahim Mohammed been carry her daughter (14years) enter him room, con take advantage do touch-touch with her plenty times.
Upon interrogation, Ibrahim Mohammed con confess say, him do touch-touch with her only 5 times since him don know her almost two years. Ali Isah, 68 years, wey dey old enough to be her grandpapa been also confess say, him also do touch-touch with the girl too. When dem ask her if she dey feel pain inside her private part, she said no... Heeeey... This one mean say, dem don rape am plenty times and she don dey use to am... She later confess say the suspects also do touch-touch with her friend, (15 yrs) but we never know her name.
Chai! See as dem spoil this small girls for nothing...
No comments:
Post a Comment