Saturday, February 16, 2019
See Drama As Victim Cut Rapist Manhood With Razor For Katsina
From ALI INA...
Information wey Police been obtain from the Kankara General Hospital, Katsina State, naim lead to the arrest of one suspected rapist, wey na the victim commot him manhood. The suspect, Bishir Yau, of Yargase village, dem been rush am go hospital for treatment. After, information about all him atrocities con leak for police, na there him bolom-bolom con burst. We learn say the victim struggle sotay, she been no dey successful to free herself from the way wey Yau been hold am. Na so she just commot razor blade wey she con use cut off the man manhood. According to the police, the 30-year-old suspect, been use cunny-cunny carry the 14-year-old victim wey been dey live for the same compound with am, go one nearby uncompleted building, where him con rape her. Na so she struggle till she no firt again, she con commot razor blade wey been dey with her, take commot the man manhoodβ¦ The police don already charge Yau with rape under Section 283 of the Penal Code. The suspect, wey dey currently on bail, dem don direct am say make she appear before one Katsina Senior Magistratesβ Court on April 4, 2019, for arraignment. The police prosecutor, Inspector Sani Ado, tell the court on Friday say, investigation for the case don complete. The presiding Magistrate, Fadila Dikko, con direct say make Yau appear before her tooβ¦ Katsina
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment