Friday, February 22, 2019

How I Was S*xually Harassed By Filmmaker And Marketer - Blessing Egbe

E be like say the issue of byforce touch-touch harassment for film people for Nigeria wey we dey call Nollywood, don dey underreported these days ooo.
Blessing Egbe, wey be Nollywood actress and β€˜Lekki Wives’ creator, don narrate how she be victim of byforce touch-touch harassment by one filmmaker and marketer.
As she dey talk for one interview with Everything Entertainment, the actress wey no gree call the name of the filmmaker talk say him try to do byforce touch-touch with her in exchange for movie roles. Blessing Egbe wey narrate how d thing happen, talk say;
β€œThis harassment been come from one prominent writer, producer, director wey been just wan try him luck." She say she been don call am before make dem talk about the possibility of working together. Na so him con give am appointment wey she been respect. The meeting been dey for one hotel, no be him office. Ahn Ahn!  She con ask am why dem dey meet for hotel and him talk say, d hotel na makeshift office… Say na something wey him dey do when him wan get time to write. Na so Blessing con believe am, con follow am to the makeshift office.

When dem enter,  na so him give her script make she read, as him no con dey satisfied with the way she read am,  him talk say him go fit write the wan wey go fit her because the cast for this particular project Don complete. As a sharp man,  him con add say if him go do dat one for am,  she go gats dey come around dey follow am go anywhere wey him dey go,  so dat the inspiration go fresh for him mind... But as a Sharper girl wey don code d direction of this talk,  na so she tell am say no wahala... But make she first go discharge her cabman so dat dem go begin celebrate. The next time wey d guy hear from her, she dey road dey go her house... And na the last time wey him hear from her be dat... She also talk say no be only him don try dis kind thing with her and no be only her dey face dis kind harrassment for the movie industry... Hmm Nollywood people wey dey do dis kind thing no worry,  one day monkey go go market,  e no go con back again...

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land