Friday, February 22, 2019
One 23-year-old-man don enter gbege, sake of say, him allegedly kill him wife with axe for Jigawa State...
One Dutse Magistrate court for Jigawa State don remand one 23-year-old man, Shaβaibu Adamu, of Warwade village for Dutse local government because say him allegedly kill him wife with axe.
The prosecutor, Barr M.Fagam, tell the court say, dem been accuse Shaβaibu say him kill him wife, Usaina after she refuse to comply with him request say make dem settle their differences, wey dem been get for their matrimonial home.
Him explained say, the incident happen when she been decide to move go her parentsβ house and the accused person follow her to plead with am, so dat she go fit come back to him house.
However, on her way, na so Adamu allegedly use axe to hit her plenty times ontop her forehead.
The prosecutor talk say, after the incident, the accused been leave the late wife body for the bush, then him con run.
Magistrate Muhammad Lamin Usman talk say, Adamu committ culpable homicide, wey dey contrary with section 221 of the state sharia Court wey dey punishable to death after convictions.
The accused, been however, deny the allegation, as him talk say, the deceased been die for her parents house after she commot from him house when dem been get misunderstanding.
The magistrate, con adjourn the case go March 27, 2019 for further hearing.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
New Gbege Wey Just Land
-
As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take styl...
-
Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here ππ½ http://ducolomal.com/1qMQ ππ½ skip d add and allow...
-
No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link ππ½ http://locinealy.com/1FaJ ππ½ and try dey ...
-
Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here ππ½ http://triabicia.com/Ghf ππ½to ...
No comments:
Post a Comment