Tuesday, February 26, 2019

CTA Don Carry Cry Ontop the Performance of Security Agencies During Nigeria Election


The Centre for Transparency Advocacy CTA don carry cry for ontop social media say dem no dey happy with the conduct of security agencies during the presidential and national assembly elections wey happen on Saturday. The CTA been clap for media organizations across the country say dem do very good work as dem guard the democracy of Nigeria well-well especially for their minute by minute report, even up till now. While dem talk say, the security officials been perform below expectation during the electoral process.
The Organization talk say the presence of the security personnels been no make any difference because e no prevent the actions of thugs and hoodlums.
We been get reports of thugs wey show up for some polling units con dey harass and intimidate voters. This kind thing wey dem do, con dey scatter the peaceful course of the election process. We been hear case of Thugs shooting and killing voters for one ward inside Rivers state even of thug harassment of INEC officials for the same state.
More so, Lagos state, dem burn ballot box for one ward for okota and na after people don vote.
For Osun state also, we hear reports say thugs threaten electoral officers, and even electorates for Iba village. This one na  just to mention few out of the many cases wey dey.
Because of  these happenings wey happen for different places across the country, The CTA don call out to the security agencies for one statement wey dem describe as β€œunpurposeful”, dey accuse them say dem no do anything to stop these criminal actions during the election.
The organization been  issue this statement on Sunday afternoon as dem been gather reports from their  observers wey dem dispatch across the country.

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land